I just saw a post about someone who discovered they were Nigerian after taking their ancestry test and wanting to know more about the tribe and country.
Just to scroll down to the comment section and the first line of the first comment was, "Unfortunately, Nigeria is a mess now blah blah blah"
Omo! (Switching to pidgin atp because dis tori/rant na for we wey be Naija)
As I read dat thing bah, e con be like say make ground just open mouth swallow me. I go tok why..
- Make una epp view dis skinerio fes: Pesin come find im papa wey im never see for im life. E enter the village wey dem tok say im papa dey live; im see you con dey ask you, you know my paale Mr. Gregory Nwafor? You con say, yes o, I no am. Na one ogogoro man wey dey sleep for gutter wey dey near my street.
Even if na true, elenu ponmo, na pesin moral you just kill, incase you no no.
- Naija no too bam now, we all know. But your chochocho no go change mata. Even oyibo tok say pesin no suppose dey wash im dirty linens for outside. Make una dey try cover una nyash smor smor nah, haba!
Bdw, nowhere really bam o, this grass dey green on the other side mentality no go epp any of us. Again, if no be say Naija dey fok up, wetin pesin dey find for another country? And we don waka waka sote, every country including the ones wey dey in the same boat with us; don get mouth to dey tok to us anyhow.
Las las, na the info wey we dey give dem for social media because of likes/views/chicken change, na im dem dey use insult us.
- If na oyibo group or subreddit, comments no fit dey like this.
You go just dey see, "I'm happy for you", "Congratulations on your results", "Oh hey, I'm also 45% Nigerian" "I can put you on, just send a dm" Very demure sontin. Awa own no dey dey like dat, and e bad. O ga o
2027 na election year, na you go choose wheda you wan use the energy wey you dey use do chochocho online, go vote dat zombie comot; or spend anoda 4 years dey give gist dey dem no ask you.
Rant over.